Music Producer and Amapiano pioneer, DJ Sumbody don die, management Sumsounds music confam am.
Di family tok-tok pesin Mmanake Mokitimi release one press statement to confam di report say investigation still dey go on to confam di cause of DJ Sumbody death.
Local tori pipo for South eNCA also announce am as breaking news for dia early morning show ‘The South African morning'
"Dem kill di music producer and Amapiano pioneer in di early hours of di morning for Johannesburg.
“Unconfam reports say dem shoot and kill di DJ .”, eNCA announce am.
But im management say dem no fit give details of im untimely death but tok say di artiste bin run into an unfortunate inciden
0 Comentários